2026 Lexus GX Price in Nigeria: Full Specs, Features & Tokunbo Cost

 

INTRODUCTION:




The 2026 Lexus GX don finally land for Nigeria, and this one na the real off-road king wey Nigerians don dey wait for.


If you dey find SUV wey fit handle bad road from Warri to Port Harcourt, carry 7 people, and still give you Lexus luxury, na this GX be am.


Today I go break down the price, tokunbo cost, fuel consumption and why e better pass RX for Naija roads.





2026 LEXUS GX PRICE IN NIGERIA





- Brand New: ₦150,000,000 - ₦190,000,000

- Tokunbo (Foreign Used): ₦120,000,000 - ₦160,000,000

- Nigerian Used: ₦95,000,000 - ₦125,000,000


 



FULL SPECS & FEATURES


- Engine: 3.4L Twin-Turbo V6 - 349 Horsepower

- Drive: Full-Time 4WD with Crawl Control & Downhill Assist

- Seats: 7 Seats (3 Rows) with fridge for center console

- Fuel Consumption: 12-13 Liters / 100km

- Ground Clearance: Very High - Perfect for Naija bad roads





WHY POLITICIANS LOVE LEXUS


Nah why you dey see say politicians dey like get Lexus for their garage, because them know say in times of bad roads Lexus dey answer, in times of flood Lexus dey answer. I give you my word, go any politician house you go see Lexus for their garage.


Lexus na one of the way be say any body fit afford, e no be like other cars like Lamborghini, Rolls Royce, Mercedes-Benz, Tesla, Bugatti. All that na the same, na why Lexus go always stand till eternity and the rest never start.





RX VS GX - WHICH ONE YOU GO BUY?


- RX: For smooth road, better fuel, Lekki and Abuja lifestyle - ₦105M

- GX: For bad roads, big family, real off-road power - ₦120M


If you stay for Port Harcourt, Warri or anywhere wey road no good, GX na the best choice.


Follow for More Lexus Car Content


Lexus for Life!



Comments

Popular posts from this blog

Lexus Bends RZ Into Donut and Twists RX Like Towel – MOTOMORPHOSIS New York 2026

2026 Lexus RX Price in Nigeria: Full Specs, Features & Tokunbo Cost

Lexus Shocks The Market - 2027 TZ Starts Under $65K